Nigeria vs Zimbabwe live updates: Nigeria vs Zimbabwe: First half end 0 – 0 for di World Cup Qualifiers for Uyo

Wia dis foto come from, X/@NGSuperEagles

25 March 2025, 16:26 WAT

New Informate 2 minutes wey don pass

Nigeria dey host Zimbabwe for dia sixth 2026 World Cup qualifying match.

Nigeria go expect to follow up dia away win by claiming anoda comfortable three points against Zimbabwe wey play 2-2 draw wit Benin, but currently dem dey sixth position for group C.

Di game dey scheduled to happen by 5pm West African time on Tuesday evening March 24 2025.

Dis match go take place for Godswill Apkabio stadium for Uyo Akwa Ibom state.

SECOND HALF

51” Camera just show Peter Obi for di stand, e wear Nigerian jersey

50” Iwobi miss fantastic chance to put NIgeria in di lead

48” Chance for Nigeria as Iwobi pass to Chukwueze but e make a wrong move and play am wide

46” Second half don start

FIRST HALF

45 +2 Nigeria 0 – 0 Zimbabwe.

Referee blow whistle for Half Time

45” Referee add two minutes extra time

45” Nigeria dey try again, Iwobi get di ball and fire shot but e go over di bar

42” Nigeria dey try hard to find di net, back to back but Zimbabwe defenders dey tight for di box and no dey gree dem

40” 5 minutes to di end of di game and both sides still dey struggle to find di net

31” Chance for Nigeria! Chukwueze fire shot but deflection and di goal keeper catch am easily

30” 30 minutes of play and di game still dey goalless for di Uyo stadium

27” Ekong concede throw in for Nigeria to avoid stories for di box

16” Nigerians dey press Zimbabwe, Moses Simon get anoda chance for di box but again, na missed chance

15” Nigerian Lookman get di ball inside di box and fire shot wey hit di bar

14” Great chance for Zimbabwe, Walter catch di Nigerian defence and fire shot wey hit top of di net

12” Anoda foul against Aina and Nigeria, Zimbabwe take am but e go over.

10” Zimbabwe keeper dey down, e try to catch ball from di Nigerian player but injure imsef

8” Lookman take di piece, Oshimhen head find di ball but dat na almost as di keeper catch am

7” Corner kick for nIgeria, Lookman dey play am

7” Zimbabawe with anoda chance but dem play a wide

3” Foul against Nigeria by Chukwueze, Zimbabawe play di free kick but e no go anywhere

2” Chance for Nigeria as Iwobi pass to Simon but e fire am straight enter Zimbabawe keeper hand

1” Referee don blow whistle match don start

Line up – Nigeria

Di line up for di match don alreadi comot as di Super Eagles go dey defended by Aina and Osayi as wingbacks.

For midfield, na Ndidi and Iwobi dem go manage tins for dia.

While Victor Osimhen and Lookman go lead di attack line.

Source link
[ads]


Discover more from Canvas Home Wholesale.com

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Leave a Reply

Scroll to Top